Miss Simplicity- Charles Inojie wey be ogbonge Nollywood actor wey Baba God sama wit girl pikin on May 25th for Decatur, Georgia, US naim d wife don sama us wit d baby name as Onoseta Obehi on top her IG page o nd she tok sey she see pepper before she fit get belle o nd she advice pipu sey wen dem dey beg God for any tin make dem no give up bcos Baba God no dey fail o. (see more pinshures afta)
She tok sey wen her first pikin reach one yr, she pray to Baba God for anoda one o bt He no give ham answer sharp sharp o nd she tok sey pipu laff her even her mama sef make d mata worse o base on sey d mama sef come dey disturb her sey her pikin don reach to get younger sista or Broda o....Hmmm she tok sey she see hell until Baba God come bless her so o... She tok sey make God help us o, make God barren women wit pikin o bcos e no easy. From TPN we dey sey congratulobia to Mr nd Mrs Charles Inojie o nd we dey pray sey make Baba God o make him protect the baby.
No comments:
Post a Comment