Wednesday, June 1, 2016

(FOTO) CHECK OUT OUR OGBONGE AFRICA SWEETHEART HAIRDO WEY HOT PAS FIRE....




Miss Simplicity: As e dey hot, na evrybodi knw sey Yemi Alade na one singer wey like Africa cultures wella infact na she gan-gan be Africa Sweetheart base on d songs wey she dey sing nd her dressing. All her albums na albums wey full wit correct correct beta songs wey dey ginger person, albums like "Kings of Queens' nd Mama Africa. Make I no lie una pipu love d way she dey like bring out her African heritage nd d way she dey sama us wit beta beta Africa cloth nd hairdo. Me as a person love all her hairdo nd since everywhere for media full wit her styles naso me sef come sey make I sama una wit six of her ogbonge hairdo wey make sense die, make I no lie una, Yemi Alade know wetin fit her nd wetin fit make her fine. Make una feel her "Fringe Puff, Half-Fro, Big Bantu Knots, Purple Wrap Around Braid, Mohawk Fro nd her Coily Wrap Around Braid...." (see other fotos under) 



No comments: