Miss Simplicity - Tubosun Olowe wey we knw as TeeBeeO wey be Producer, Sound Engineer nd Songwriter sama him model girlfriend Queenneth Tariah wit surprise yestaday for him birthday dinner party wey e be sey sum of him family nd friends attend o. TeeBeeO ask him babe d question wey most ladies dey like hear from guy wey dem dey date o, "Will You Be My Wife??? Nd trust Queenneth naw she sharperly sey "Yes"... As TeeBeeO hapi reach, he sharperly post all d pinshures for him IG page nd on top ham he write sey "BirthdayExtravaganza And she saidYES!!!... together forever baby!" Yes oooo we for TPN dey tok sey Congratulobia to TeeBeeO nd Queenneth o.....too much love See hw d mata waka for d pinshures wey we go post afta d cut.....







No comments:
Post a Comment