Wednesday, June 1, 2016

(FOTO) KIM KARDASHIAN WEST No GO USE HER FINENESS ND SWAG KILL US SHA....SEE HOT SHE MAKE SENSE

Miss Simplicity- Kim Kardashian West wey  be 35yrs old nd mama of two pikin nd wey dey weigh 132lbs naim don com out come tok sey she still get 12lbs to go before she go get her goal weight o.
She openly tell her IG followers hw her weight loss journey take start o nd hw she take dey follow her diet plan wit exercises wella o make she for fit loss weight o.
Kim tok sey she don dey follow Atkins diet plan o, sey she don learn how to take dey eat differently now o.
Kim com sama pipu wit her pinshures wey she take yestaday wey she go one meeting for Santa Monica for California make dem for see hw she don lose weight reach o...
Na so, na so, dis lady dey gbono feli feli for dis pinshures wey she no use make up so nd she no be like person wey don drop two pikin...
Carry waka abeg, ur head dey dia ma'am Kim....

No comments: