Wednesday, June 1, 2016

CHAI... BABE WEY DEM TAKE ACID BAFF DEY CRY FOR HELP O, SAY SHE NO WAN BLIND

Twenty-six-year-old Jamila Musa from Edo State, wey dey wok with Flour Mills of Nigeria, nahin on Sunday, dem pour am acid for her house. At about 10pm, tori yan say she hear one familiar voice for her door, say  he get one message from her boyfriend. Jamila, yan say she don dey suspect say her boyfriend don marry plus the wife dey always threaten am. So as she con hear say the voice na the wife brother nahin make her open door. She tok say as she try open the door nahin the guy poor am acid for face. After five minutes wey she con get chance open mouth shout for help nahin pipu for the house com baf the face con chuk honey plus pap ontop am. She yan say wen she see say her boo don get anoda boo nahin she don dey tell am sake make den stop all the relationship sake of say e no go make sense to dey chop anoda man wife. Dem don report the mata give police and den tok say dem go arrest the boo plus hin boo with her brother.

No comments: