Wednesday, June 1, 2016

WE NO DEY PLAN TO SELL SCHOOLS O, OYO STATE GOVERNMENT DEY POLONGO

OYO State government don yan say na lie say dem wan privatise public schools. Dem yan say wetin dem bin get for mind na to enta Public Private Partnership (PPP) plus return some schools to dem original owners. Special Adviser to the Governor ontop Communication plus Strategy mata Yomi Layinka yan this one yesterday wen E dey gist news men for IB city. According to him, the state reason dis one because say ma for over 40 years nahin missionaries plus communities dem don dey beg government say make den return sem schools give dem bak. The governor's aide con note say no be all schools go dey the pakage, E yan say e get criteria wey dem go take sabi wether school qualify abi e no qualify.  He yan say dem obe do dis one sake of say dem wan promote qualitative education.

No comments: