Olajumoke Orisaguna, wey bin dey sell bread before she turn model, don say na lie o, she no rub any juju for body the day wey she jam TY Bello, wey come blow her. The 27-year-old, wey turn popular jingo afta she waka pass where TY Bello dey snap pinshure say she still dey hustle to see say life pure for her and her career for modelling stand wella because she no wan suffer again. She say she thank God for that day sake of say she no rub anything for body, even cream she no fit put for body that day before she run go bakery that day. She say she Neva do juju for her life and smallest mark wey dem dey take do juju no dey her body sake of say she no like make mark dey dey for her body. She say her parents na good Christians and she sure say na because of am dem do dat photoshoot.
No comments:
Post a Comment