Wednesday, June 1, 2016

FG SAY NO WINSH FIT STOP DEM FIGHT AGAINST CORRUPTION

The Federal Government don yan say dem no go stop dey  fight corruption plus say dem go shine light, catch con still punish anybody wey chop for we country money. The Secretary for Presidential Committee ontop Anti-Corruption, Professor Bolaji Owasanoye, yan dis one for one State of the Nation conference wey the Nigerian Bar Association arrange, E con yan say 21 out of 36 states nahin don enta wahala now because of corruption. He con warn say those wey dey cover ‎corrupt pipu say make dem change because if federal government catch dem, dem no go escape am. The Chairmo of the NBA Committee ontop  the administration of justice‎ con yan say make dem dey sharperly judge criminal mata dey important like one member of the House of Representatives, Lynda Ikpeazu, polongo say the legislature dey plan to amend the EFCC and ICPC Act.The Presido for the Nigerian Bar Association (NBA), Augustine Alegeh, con advise the Federal Government say make den take steps to re-arrange issues of security plus we economy.

No comments: