Thursday, June 2, 2016

ECOBANK TOO DON FREE OVER 1000 OF DEM WORKERS

Na on Tuesday tori dey waka round say Diamond Bank Plc don collect work from like 200 of dem workers, FBN Holdings wey be mama for First Bank of Nigeria Limited, too just yarn for time wey no too tey say dem wan free 1,000 of dem workers. Anoda tori wey dey show face today be say Ecobank too don ready to free over 1000 of dem staff and pipu wey dem free na full time plus contract workers. One of dem top Oga confirm am give punch say na like 1,400 pipu dey for the first list, na when dem come see say the figure high dem reduce am to  1,000 plus small. But dem megaphone gangan for the bank no gree talk on top number of pipu wey dem dey free. But for statement wey she sama public she say dem converted over 200 pipu wey dey work for dem outside to permanent workers as dem dey try to encourage pipu wey dey work well so dem go fit dey do more. Dem say dem even dey increase money wey dem dey give pipu wey work well for different levels.

No comments: