PDP BOT wey Senator Walid Jibrin dey siddon on Wednesday don collect power wey dem take dey run the party. The Chairmo for the BoT, Jibrin, na him polongo Dat one for one meeting wey dem follow dem party workers do for dem National Headquarters wey dey Wadata Plaza for Wuse, Abuja. We hear say Jibrin say na different court order wey dey yarn different things make dem kuKuma collect the power wey dey cause quarrel. He clear dem staff wey dey the meeting say dem party constitution no gree make dem no get Oga and Dat na why dem wey be BOT dey carry head enter the mata, nobody sha don take dem go court. Jibrin stullpexplain say all the gbege for the party go soon commot for ground however explained that all and pipu wey dey fight dey do well to see say dem settle the quarrel.

No comments:
Post a Comment