Sunday, June 5, 2016

BABA GOD DON SAMA RITEISH ND GENELIA DESHMUKH WIT ANODA BUNDLE OF JOY OO



Miss Simplicity -As e dey hot o, as my simple leg don make me kawasaka enta India, na so I sey make i check sum of my frds, na dem com dey yarn me sey Riteish nd Genelia Deshmukh wey be one of d best couple wey Bollywood get wey born their first pikin, Riaan for November 2014, naim Baba God bin bless wit anoda boy pikin two days ago o bt na today dem discharge her from d hospital nd her mother, mother-in-law, husband nd pikin naim come carry her nd d new pikin from d hospital, dem post for pinshures nd d joy wey dey d their face na sum tin wey dem no for hid o.



Tho dem neva tok d pikin name bt d family o tok sey dem dey hapi for dis bundle of joy wey Baba God sama dem wit ooo... Yes oooo me sef dey hapi for una two wey dey among d best actor nd actress wey I get for Bollywood o... From d very TPN Stable, me dey wish una two "Bahot bahot badhaaiyaan aapko aap ke bacche ke liye" dat is to say Congratulation for d new baby ooo
See d family pinshure afta d cut...



No comments: