Wednesday, June 1, 2016

ASUU FOR UI DEY PARA SAY HALF SALARY NO DO DEM AGAIN O

Academic Staff Union of Universities (ASUU) for University of Ibadan (UI), don dey ready to start gobe with dem authorities on top half salary wey the school dey play dem from January 2016 to May. ASUU Chairmo for University of Ibadan, Dr Deji Omole na him yarn am on Tuesday say union members no fit get patience again, so dem don decide say dem gats collect dem full salary from the Federal Government, as per say half salary no do dem again. He say from January 2016, dem no dey pay salary complete and dem don dey form say dem dey understand as dem dey promise dem say things go change alaries when presido sign budget, but as he sign budget finish na him he carry petrol money go up instead make he sama dem wetin go make life beta. But the Oga patapata for the school, Prof Abel Idowu Olayinka explain say Federal Government dey owe dem school N782 million, wey no let dem fit pay complete salary and do other normal things wey dem suppose do.

No comments: