Wednesday, June 1, 2016

WETIN MAKE I NEVA MARRY... OSITA IHEME



Miss Simplicity- Osita Iheme wey be ogbonge comedy actor wey we know ad Pawpaw don come out come tell us wetin make ham neva marry unlike him friend Chinedu Ikedieze (Aki) wey don marry six yrs ago o. Pawpaw for one interview wit The Sun tok sey him neva marry base on sey him dey take him time to pick o. He tok sey marriage no be one tin wey person go just rush do bcos oda pipu dey do ham o, he tok sey na sumtin wey u go do wen u ready.

Pawpaw tok sey him go marry wen him don dey fully ready o nd he tok sey on top d mata wey pipu dey carry abt sey him nd Aki dey quarrel bcos he don marry, he tok sey na lie o, sey him nd Aki dey kampe o. Pawpaw wey be 33yrs old Imo State born actor tok sey him nd Aki neva act film togeda bcos film neva dey wey dem two go feature o bt sey if any producer want make dem two act, he sey him nd Aki go act o bcos dem two dey kampe oooo...

No comments: