Wednesday, June 1, 2016

SHUU... SEE WETIN MAKE OLAMIDE VEX COMMOT FROM STAGE FOR OAU

YBNL General, Olamide Adedeji, wey plenty pipu still Sabi as Olamide Baddoo vex commot from one show for Obafemi Awolowo University (OAU) in Ife afta kasala burst when he dey  perform. Students wey dey over happy, don plenty go dem popular Amphitheater for OAU on Monday make dem go see Badoo for one show wey Motherland Beacons arrange.  Tori yarn us say as he climb stage na hin everything change,  as students dey shout, dey over happy. But as he don perform some of him beta songs for like 20 minutes, na him kasala burst and some students run enter stage. Na hin make Badoo vex commot from stage as e be like say the security pipu wey dey there no fit control the students wey din go haha again.

No comments: