Na on Friday, office of Registration for UI throway one statement wey dem take dey invite parents and pipu wey get mouth for UI mata to one kain meeting wey dem wan do on Tuesday, June 7th for Trenchard Hall, UI where dem go for discuss mata how dem go open the school again make pipu for dey learn dey go. Tori wey dey enter TPN hand say, na sake of dat meeting make some student leaders wan gather make dem first gree on wetin dem go talk for the meeting next week Tuesday, we hear say na there dem dey when police from Sango Police station go catch dem, and one of the popular pipu wey dem catch na one guy wey be SUG presido before before buy he still be Post-graduate student now, wey hin mane na Tokunbo Salako, wey dem dey call T Cool. We hear say as other student Oga say make dem go show face for Sango Police Station, go Sabi wetin be dem offence, na so dem catch those wey go, wey anoda before before SUG presido, Babatunde Badmus (BB) dey among dem. So as we dey write now, we hear say UI students don vex O, and dem dey gather body to start anoda Aluta... as dem dey claim say na UI, Vice Chancellor, Prof. Olayinka Idowu invite police for dem. So dem dey vex for the school... dem don even start hashtag for Twitter say #olayinkamustgo. The story still dey develop sha.
No comments:
Post a Comment