Tuesday, September 29, 2015

NO BE SMALL SOMTIN TUNDE OLAWUWO STILL DEY FLEX FOR OBODO OYINBO

If na me nko, I for do pass am. Tunde Lawuwo just dey waka go plenty plenty fine fine places dey snap pinshure with oyinbo pipu plus dem houses. The bros wey don first kpouf before he travel come dey fresh anyhow like latrine coackroach. I sha trust am say when time reach he go gree come back home, he no go do like some popular pipu for we city here wey dem carry go sing for oyinbo land, come run away....lol. I sha no mention anybody name, abi shey you sabi anybody like dat ni?

No comments: