Kasala burst for Ebute Road and Asiwaju Street for Ibafo area wey dey Ogun State after some bad guys enter the same trouser with policemen and military pipu, the palava come enter action film level wey dem just dey shoot anyhow for the area. Tori yarn us say na on Sunday around 10pm dem start the gobe and na so dem do till 8am on Monday wey make pipu for the area tear race commot from dem dommot. We hear say wetin cause give na when those badt guys wan collect one of dem padis wey get levels wella, wey dem catch by police for Ibafo Police Division. We hear say the big boss, wey nobody don Sabi him name na him dem catch for say dem kpain one police corporal wey dey work for the station, wey him name na Torbee Atorough.
Tori yarn us on May 25 say dem kidnap Atorough by pipu wey den suspect say dem be militants when he dey for him duty post for the community. Dem say dem still never Sabi where Atorough dey and police for Ibafo still dey find am. We hear say na him dem find reach where the vandals dey on Sunday before police come catch the vandals Oga, wey dem wan come collect back from dem hand, ma him cause action film.
Tuesday, May 31, 2016
SEE ACTION FILM O... POLICE DO GBEGE WITH BADT GUYS FOR IBAFO, OGUN STATE
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment