Tuesday, May 31, 2016

NAWA O... SOLDIERS HOLD MAMA FOR DEM DOMMOT SAKE OF SAY HER PIKIN DEY SICK

One hotel manager wey dey for Lagos State, Ms Omolara Koleoso, don accuse some soldiers for Ikeja Cantonment say dem hold am for ground sake of say she follow one of dem colleagues argue. The woman say na for full  24 hours dem take tie her for dem dommot without food, say even dem no gree make her family pipu see her when dem come. Tori yarn us say na one Oga for the barrack gats chuke mouth for the mata  before dem free the woman around 8pm on Saturday. Tori yarn us say around 4pm on Friday, Koleoso don go pick her pikin wey dey go Command Day Secondary School for inside the cantonment, after dem halla her for phone say her pikin dey sick. We hear say as she wan drive commot from the barracks, one female soldier go close the gate, say make she drop her pikin from the car, make she go join other students wey dey clean the school. The mama say everything wey she do to try explain say the girl dey sick and she wan go rest no just enter the soldier woman hear and na for there gobe start. Wen she ask why she gree make other students commot, na so she vex and dem  start to dey yab eachother. She call me bloody civilian and I tell am make she show me some respect. Anoda soldier beg her make she free us but she no gree.
Koleoso say 4 other soldiers just show, come dey lie for her head say she wan beat officer. She say dem push am, tell her say she don high, she tell dem no and tell her make she enter military post. Na so dem take hold am.

No comments: