As tori yarn us say 2 trains jam for Jebba Bridge b wey dey border of Kwara and Niger States and some pipu kpain for the mata, while some woundjure, Special Assistant ( New Media) to we Senate Presido Bamikole Omishore throway one statement say we Senate Presido, Dr Abubakar Bukola Saraki don shock and he sad for the mata, so he dey do eeyah for the family of pipu wey kpain. Saraki still follow do eeyah for pipu wey woundjure and pray make Almighty God heal dem. He still advice dem management for the Nigeria Railway Corporation (NRC) make dem shine light on top wetin cause of the accident, so anoda one no go shele again.

No comments:
Post a Comment