President Muhammadu Buhari don sacked the number one pesin for Nigerian Christian Pilgrims Commission (NCPC), Mr John Kennedy Opara,wey be chairmo for the commission. Presido still com dey yan comptroller-general of the Nigeria Immigration Service, Martin Abeshi sef say make him too vacate hin office. President Muhammadu Buhari sign say make dem disengage Mr John Kennedy Opara as the Executive Secretary of the Nigerian Christian Pilgrims Commission. Mr John Kennedy Opara wey by hinsef dey yan journalists ontop the mata, tok say David Lawal, the Secretary to the Government of the Federation yan am say the mata na papapa make him pio pio pio comot the place
No comments:
Post a Comment