Tuesday, May 24, 2016

POLICE DON CATCH AGAIN THE 15-YEAR-OLD GIRL WEY KPAIN PERSON RUN AWAY

One 15-year-old murder suspect, Gift Edosomwan, wey escape from the Edo State Children Remand Home for Ugbekun inside Benin, don enta police plus her accomplice. The suspect nahin dem say dem arrest for about 12am on Monday. Tori yan say Edosomwan nahin dem arrest for allegedly killing one 28-year-old woman, Mrs. Itohan Enagbare, plus her three-year-old daughter, Iwinosa, but pio pio pio comot the juvenile home last Saturday. The suspect plus others wey dem never catch for December 9, 2015, kpain the victims for their residence for Osaze Street, inside the Ikpoba Okha Local Government Area of the state. The teenager, wey dey live with the landlady, don show face before for one Evbouriaria Magistrates' Court. before she bounce

No comments: