Sheriff don dey beg pipu wey get mouth for PDP wey dey vex, say e no master am to dey disrespect agbalagba, and he no give power to him boys make dem reply those Baba for PDP wey dey vex. Senator Ali Modu Sheriff, wey be National Chairmo of PDP na him dey beg on top wetin him boys go yarn on him behalf. Na for one kain media meeting for Jalingo on Sunday he for dey beg. He say those Baba get right to yarn If dem see wetin dem no like for the party. He come beg dem again say na to join hands with the present Ogas for the party make the party make sense again be the koko.

No comments:
Post a Comment