Staff verification pakage wey dem do for inside Plateau State don trace 1,832 ghost teachers to one single pesin wey no even be teacher. According to Daily Trust, the state governor, Simon Lalong yan dis one for one media parley for Government House wey tanda gidigba for Jos as dem dey mark hin one year wey hin enta office for weekend. He still com dey gist say one man wey don stay for America even confess by hin sef say hin don dey comot salary for hinsef plus many many ghost wokers take fund charity for widows plus orphans dem.
No comments:
Post a Comment