The Ijaw Youths Congress on Thursday don warn President Muhammadu Buhari and him Federal Government make dem no reason am at all say dem wan catch we former President Goodluck Jonathan on top the light wey dem say dem dey shine on top how dem chop money when he bin dey government. The youths, wey gather for Wellington Hotel Effurrun wey dey Delta State, go do 2016 Major Isaac Boro anniversary wey dem dey do every year and dem topic na celebration with the topic, "The ideals of Adaka Boro and the renewed militancy in the Niger Delta: The way forward," na fit there dem dey yab the government sake of say na only time wey Jonathan be presido dem dey shine light on top. Dem presido for IYC, Udengs Eradiri, ask Federal Government make dem still shine light on top Halliburton bribery case wey shele under former Presido Olusegun Obasanjo, if dem wan make Naija pipu take dem serious. On top the new militant gbege for the area, Udengs say as dem don open Maritime University, Okerenkoko, for Delta State, make dem dey learn, he say na the first thing wey Federal Government go do before dem go fit siddon yarn on top how to stop the kasala wey dey burst for the area. Eradiri say pipu don dey yarn, dem even do meeting for Abuja yesterday (Wednesday) but he don clear dem say Dat kain meeting no go work.
No comments:
Post a Comment