Monday, May 2, 2016

HURRY... MOUNT ZION TV DON FINALLY START YESTERDAY MAY 1

AFOUDA- Shebi TPN join pipu wey first yarn una say Mount ZION films ministry don dey ready to sama us with first television station for Africa wey go dey do Christian film 247,wey go dey on Consat. So the good news be say, na yesterday wey be May 1st dem promise to start and God don answer dem prayer as Mount ZION TV DON start yesterday. So for all of una wey no dey like those kain films, wey like gospel things I say congratulobia to una. And also congratulobia to Mount ZION films especially Sister Gloria and Baba Ishawuru.

No comments: