The former Alawi wey dem dey collect ba 18k he con put 7k join am, the total Alawi now na 25k. He con talk say pipu wey dey Local government councils wey dey Edo state go dey collect dere Alawi kiakia. The Governor talk am on Sunday wen dem dey workers day at grand finale, he continue say pipu wey dey Egor Local Government council wey dem owe 13 month go collect their money within two weeks. He con promise say fuel go down, fuel no go down Edo workers go dey see alert on top their fone before month end, say he no suffer any workers. The State chairman wey dey trade union Congress (TUC) Mr Orhue Marshall con beg the government say make dem put all workers name for National health Insurance Scheme (NHIS),he con talk wetin dey behind hin talk na Bcos workers go get fast and cheap Medical Facilities like their pipu wey dey federal public service. Change don start for Edo state
No comments:
Post a Comment