Monday, May 2, 2016

AFRICAN KIDS AND TEENS FASHION WEEK 2016 DON DEY WARM UP.. HOW?

The Oga for Smartcode Africa wey be organizers of that ogbonge Fashion show, African Kids and Teens Fashion Week don polongo say dem website wey e be like say dem rest after dem finish the 2015 edition go wake up again  on Wednesday 4th of May, 2016,  and na for there dem go dey throway info plus other details about the 2016 edition of the show. But as e dey go and from wetin TPN fit see from the litu statement wey Mr. Ajibola Akande crest put for him facebook page, e be like say na Lagos go won am dis year,  COS the hashtag wey he put dey take style do ofofo give us. But Sha O, before the website wake up in a fit contact dem for for dem WhatsApp and bbm contact.
BBM Pin: 7A8DC016
WhatsApp No.: +234-812-277-0205
#LagosforkidsLagosforAfrica #Fashion #Kidsandteens #Business #Networking #Nigeria #Africa. We dey wait ooo.

No comments: