Saturday, April 16, 2016

YVONNE OKORO DEY MAKE US PROUD FOR GHANA OOO

MISS SIMPLICITY - Yvonne Okoro na one actress wey get Nigeria papa nd Ghana mama, d actress knw hw to act nd she don collect awards for her acting. Yestaday d actress go Asante city for Ghana go commission d borehole wey she dig for one small village wey dem dey call Wungu... She still donate food nd cloth to help pipu wey no get for d area. Yvonne friend wey her name be Sandra Ankobiah sef follow her go there nd from d picture wey Yvonne post, e show sey d pipu dey hapi for d borehole wey she dig o bcos before now d Wungu pipu bin dey travel 3km before dem dey get water wey dem go fit drink nd take cook...na real happiness ooo. D actress tok sumtin wey make sense o "It doesn't matter how small, be kind to 1 another, help one another and the satisfaction nd fulfilment it comes with is AMAZING.. Now d women no go dey trek 3km to get water o... Hmmm thank you for dis kindness o our dear actress...ur head dey dia...

No comments: