One fan wey no fit mind him business, don go yab Toyin Aimakhu say she go date Seun Egbegbe, wey be agbero afta she commot from her husband Adeniyi Johnson wey be graduate. The mumu fan take swear decorate Toyin life when he say na God go punish her well O, say na the love wey him get for her make am dey swear so O cos anytime he think of how Toyin dey open leg for Seun Egbegbe, he just dey hate am, he say he no fit believe say Toyin go commot from a graduate, come go join Agbero, just because of say dem cheat am abi money mata. He come still swear again with Antar Laniyan voice say na God go punish her bcos she fall the hand of many Naija pipu. Toyin Aimakhu too, base in who she be, no gree O, she return am sharperly say na Satan go punish am and scatter him life like one of the pinshures wey dey him page, she say the oriburuku wey the guy go do still dey inside cargo and all na bcos of the love wey she get for am O. More call the guy omo ale jatijati, wey him head be like pear. She come ask the popular question; who graduate help? say the guy na disgrace to men..lol.... She come finish am with olori gbigbe bi panla gbigbe..... TOYIN sha cannot stop to dey fall person hand.
No comments:
Post a Comment