As DAVIDO dey break international record reach, he still no dey rest O, cos he just dey hustle to enlarge him record and him career. Tori wey dey in top dem official website, say dem don get like 5 artists already for dem label – Davido, Danagog, B-red, Sina Rambo and Deekay . But e no end for there O, dem don sign 2 young guys join, dem be Mayorkun and Dremo. If you dey Ibadan, you go Sabi Dremo wella, cos the guy na sure guy wey dey hold him side tight for Ibadan for some time now and na Appe Gang he bin dey for IB Dat time. Mayokun na one popular actress, Toyin Adewale pikin and HKN don ready to introduce Mayorkun give Naija music industry as dem go sama us him first single “Eleko” on Friday. Na on Tuesday dem do the signing officially wey Davido legal team follow dem dey. We for TPN say congratulobia to the guys as dem don ready to blow and to Ibadan say one of we beta pikin don dey do us proud.
No comments:
Post a Comment