Monday, April 11, 2016

UP NAIJA.... GOD DON HELP US CATCH ONE OF THE PIPU WEY START BOKO HARAM


Thank God, dem DSS don catch one Mohammed Usman wey dem still sabi as Khalid Al-Barnawi, and dem say the guy na one of the pipu wey start Jama’at Ahl as-Sunnah lid Da’wah Wa’l-Jihad alias Boko Haram and he come go become Amir for one group wey break commot. go start dem own, Jama’at Ansarul Muslimim Fi Biladi Sudan (JAMBS). Tori from DSS yarn us say na the guy be the person wey plan how bomb take blow on August 26, 2011 for the United Nations building wey dey Abuja. The DSS say as dem catch am so. Na beta thing for we fight against terrorism.

No comments: