Monday, April 4, 2016

TOOR... AFTA PLENTY DRAMA, TOYIN AIMAKHU SAY SHE DON BORN AGAIN

MISS SIMPLICITY - Toyin Aimakhu don com out com tok sey she regret sey she bin dey post her relationship for internet o nd she tok sey she don learn her lesson o...sey she no suppose post her relationship wit her husband Adeniyi Johnson nd Seun Egbegbe for internet oooo. She tok sey she no go do ham again ooo bcos most of d pipu wey dey read post for internet no get wetin dem go do to help o, dem go only dey use ur mata dey entertain demselves. Last last she com post Beyonce nd Jay Z foto sey make celebrities dey imitate dem sake of sey dem two no dey post their family issue for internet o... Hmmmm e be like sey sumbody don tok sense for ma'am Toyin head...nice advice ma'am, I pray make pipu listen...

No comments: