Monday, April 4, 2016

AFTA MERCY AIGBE, SEE WETIN MAKE YOMI FASH-LANSO TOO DEY PARA FOR NOLLYWOOD

MISS SIMPLICITY - Na Mercy Aigbe first para now Yomi Fash-Lanso wey no dey like tok for media sef don para too for one interview. D guy tok sey him no get time to dey tok English o base on sey English no be him papa lingual nd dat one no show sey him no wise o. He tok sey if person tell u sey u no sabi tok English, sey make u ask d person sey " English na my mama language? Sey if d person tok sey no, make u tell d person sey he stupid..Hmmmm Yomi tok sey many oyinbo na drop out o. He tok sey pipu like Bill Gates nd Einstein no finish skul bt dem fit speak English bcos na their mama tongue. Yomi fash don tok sey dem no fit force ham tok anoda man mama tongue o, e tok sey dat one na " Stupidity on him Personality" he com still tok sey if we no stand up to uplift their culture nd language, we no go be anytin for oyinbo pipu eye. Last, last Yomi Fash com tok sey him o dey proud of him culture nd him language...Hmmmm.....me sef tire ooo, na English be our mama tongue for naija???

No comments: