Naija man, wey be gay, Kenny Badmus wey run go USA afta he make am public in January 2015, don climb him Facebook page to say he no happy say he no fit one back home, as e dey fear say pipu fit gather hand beat am die. He say to come home dey hungry am but he still dey hapi say he fit Waka freely for US as gay man, and he no dey fear anything. But he for like make he fit come home come pit flower for him Mama grave, make he come see him twin sister wey dey always like to criticize am. He sha talk plenty things wey he miss sha. Bros if truly you dey miss dem, repair your way make you dey come na.
No comments:
Post a Comment