Tuesday, April 5, 2016

TUFIAKWA... SEE WETIN MAKE WOMAN KPAIN HER PIKIN, DRINK HIM BLOOD FOR IMO

When I first hear am,  I think say na outside Naija O,  but tori yarn us say the bad thing happen for Onicha Uboma Autonomous Community, for Imo State. The woman, Ifeoma, kpain her 1-year-old baby, commot the baby eyes come drink him blood, inside her husband shop. We hear say Azubuike Emedom her husband leave the baby with her travel for business mata, na when he show back next morning he see say the Mama and the pikin dey miss. When he get to him shop,  he see say dem don lock am from inside,  na so the guy breakdown the down to the shop, he discovered afta he don knock taya. Na so he see him wife, Ifeoma inside with blood for her mouth and the baby wey dem wrap inside cloth wey blood don stain. He sharperly commot the cloth from the baby body to see say she don kpain and dem don commot her eyes, break her hand and leg . One of the community leaders say he believe say Ifeoma na mammy water, and na sacrifice she take the pikin do. alleged that Ifeoma is of a marine cos when dem catch her na blood fuller mouth. Dem say some months ago, she don first try to kpain one woman for dem community wey she woundjure with knife. When he dey conform the mata, DSp Andrew Enwerem, the megaphone of Police for Imo, he say dem still dey shine light for the mata.

No comments: