E good make person dey give himself beta name sha, when Eniola Badmus dey call herself Gbogbo Bigz girl, e be like say she dey play. Now she don dey big for real as dem don polongo her join Etisalat ambassadors. Na some weeks ago dem Loud am and now dem don release her official advert pinshure for the company. Na Etisalat climb on top dem social media go welcome Eniola Badmus come even use one slang wey dem dey try trend for dem advert, "You still dey there?? Shoe still dey wear you??? With Dat one now she don join Olamide, Ice Prince plus Francis Odega (Mr Gherarahere as Etisalat ambassadors.
Tuesday, April 12, 2016
SEE LEVELZ... ETISALAT POLONGO ENIOLA BADMUS AS DEM AMBASSADOR
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment