Thursday, April 21, 2016

SEE LEVELS ...DEM DON MAKE TUBABA AMBASSADOR FOR CAMPARI



MISS SIMPLICITY - No be small tin, veteran artist wey we knw as tuface idibia naim dem make d ambassador for one alcoholic drink wey e name be Campari wen dem dey do dis yr Nigerian Entertainment Conference, NECLive4. Tee A wey host d conference naim introduce tuface for stage nd d artist


 come wit him manager. Na for dia naim Efe Emerogbo wey be chairman for Now Muzic nd wey be Campari representative take announce sey na tuface be d new ambassador for Campari nd tori tok ham sey tuface hapi for d deal nd he tok sweet sweet words on top hw him nd Efe go take make moni for d brand...nd for d stage dem share toast of Campari drink.. We for TPN dey sey congratulation to one special artist wey dey make Naija proud for everywhere

No comments: