Omobola - Naso he talk dis yesterday when he dey with the united States secretary of state, Mr John Kerry, at Washington DC. He con continue say some koko dey inside the proposal wey say dey don comot and put wetin dey want, the presido con talk say he go sit down check am wella so hin mind go dey at peace. Mr Kerry con tell our presido say make hin put his mind at rest say the united state government dey hin back and dem go help Nigerian return all wat dey don carry away wey dey in billions of dollars. Mr Kerry con continue say the united state government officials go meet with the chairman of Nigeria's Economic and financial crime commission(EFCC) to yarn the matter with them and he con talk say security too go dey for all Nigerians.
No comments:
Post a Comment