Wednesday, April 6, 2016

LOL... SEE WETIN MAKE PDP SAY MAKE APC CARRY DEM CROSS AND STOP BLAMING DEM

As APC DON continue to dey blame the former government and PDP for all the nonsense wey dey shele for we country, the PDP don asked dem for APC, make dem stop to dey blame joor, na solution make dem find. The PDP Chairmo, Alimodu Sheriff yarn dat when he dey form 4 committees for the PDP for Abuja yesterday April 5th. HE say dem feel the suffer wey Naija pipu dey suffer for APC hand. He say make Naija pipu compare the two government for demself by demself. He say he see one of dem leaders dey blame dem party for petrol wey no dey after dem don do almost one year for office. He say na how to rebuild dem party dey dem mind O, so make everybody carry him own cross. Lol

No comments: