For the Bukola Saraki property mata, wey start yesterday, one witness yarn how Bukola worker dey carry plenty money go put for the senator account. Federal Government’s witness, Michael Wetkas, wey be public servant and a Principal Detective Superintendent for EFCC yarn before the Code of Conduct Tribunal (CCT). He say money wey dey go like millions of naira na him dem dey go pay enter Saraki account everyday by him personal assistants on domestic mata. He say one Abdul Adama na him carry money like 600k and 900k for 50 different time for one same day enter GTB, Ilorin, his colleague, Ubi, wey dem no fit remember him surname still pay the same money like 20 times for one day enter the same account. All dis na him follow as tribunal throway Saraki application say make dem push the mata go forward. Saraki through him plenty lawyers wey be like 80, wey Paul Usoro (SAN) plus Mahmood Magaji (SAN) lead dey yarn for am
No comments:
Post a Comment