Shebi na for football dem dey talk am say e never finish until e finish. Today na last day of semptember true true but e never finish cos we still dey expect say Sai Baba go yarn us the name of the pipu wey go follow am work for him government. Na him don first say make we relax na dis month he go yarn us, but sha yesterday he polongo say na him go siddon on top ministry of petroleum wey be the surest place where we for dey make money and where dem for dey thief money for Naija. So we siddon dey look time if presido go fall our hand no release the names as he promise dis month abi he go do am again like he polongo him property small time before the 100 days for office wey he promise us.
No comments:
Post a Comment