Tuesday, April 19, 2016

BARCELONA STILL FIT WIN LA LIGA - LUIS ENRIQUE

Barcelona oga Luis Enrique say him side still fit win dem final 5 La Liga games to collect the title even as dem don flog dem 4 times now for dem last 5 games as Valencia flog dem 2-1. SEE AS life dey happen O,  dem bin don play  39 games wey nobody beat dem O, till Real Madrid come spoil dem juju early this month, and since den, e just be like say dem ko Sabi again cos dem don throway the 9 point advantage wey dem bin get for top of the table and to come still put sand for dem gari, Atletico Madrid don flog dem commot from Champions League. Barca now don still loose dem last 3 LA Liga games for the first time now in13 years.

No comments: