OMOBOLA - The All Progressive Congress (APC) wey dey Ekiti state don para for Fayose on top the letter wey he send to the China presido say make dem no borrow us any loan. The APC publicity secretary Taiwo Olatunbosun con talk say make dem challenge Fayose, he talk say na only him dey spend Ekiti money,
he never pay four month salaries for workers, doctors no work, Ekiti Pipu dey die for hospital, he con yarn say if only him dey enjoy make he dey enjoy go, say make he no put mouth for federal Republic matter. He con finally talk say PDP governors self dem dey always day Aso rock wia dem dey make peace and talk about how their States go develop, Fayose con turn himself to enemy of progress, he con dey against better tin.
No comments:
Post a Comment