Monday, April 18, 2016

NAWA O... FUEL PALAVA DON STILL KPAIN ANODA MAN FOR LAGOS

Fire don kpain one 45-year-old man for the C Close, FESTAC Town, Lagos State, afta one keg,  wey he take carry petrol for inside him car catch fire. Tori yarn us say the man go buy the fuel for one filling station for him around 3am on Saturday and he drive him Peugeot 307 car go house without any palava. But dem say na something do the fuel wey make am catch fire inside the car. Dem say every every wey firefighters from Lagos State Fire Service do to save the man no gree work as the stubborn fore born the poor man die. One of dem officers for fire service, Amodu Shakiru, say nobody sabi say the man dey inside the car until him family pipu come. Shakira say dem still dey shine light for the mata but dem believe say the man get lighter abi cigarette for him car.

No comments: