Wednesday, March 2, 2016

WOW...POPULAR CELEBRITY PHOTOGRAPHER FOR IBADAN, OLERE DON BORN O!!!

See groove for Ibadan o, na parry o. Popular celebrity photographer wey base for Ibadan, Olamidipupo Akinpelu Akinfenwa wey everybody sabi as Olere and him beautiful wife don welcome dem first born. Na yesterday Olere climb on top Facebook sama us one kain coded message with the baby pinshure come write Psalm 100 put. But some of him friends don already dey congratulate am online on top say Olere now na Papa. How time dey fly sha, I still dey remember the pinshure I see when he propose give him wife for one PETERU show like dat. And now family don set. We for TPN say congratulobia to Oga Olere, we no just sabi maybe na dat yesterday wey be March 1st dem born the bebe ni abi na Monday wey be 29th February. Any which way the parry no go pass us.

No comments: