Wednesday, March 23, 2016

WOW... SEE AS OLAJUMOKE FLOG ADEKUNLE GOLD, FALZ AND OTHERS ON TOP GOOGLE LIST



Na WA o... SEE AS GOD just dey butter dis babe bread anyhow, Olajumoke ORISAGUNA,  wey bin dey sell Agee bread Dat year,  don turn celeb overnight. He celeb levelz sef come pass Dat of many of we celebs from tey tey. Na so anoda report show face yesterday again say na Olajumoke pipu find pass for Google for Naija. (SEE the full list afta the break)


The list wet dem release get 10 pipu wey pipu find pass for Google for Naija, and many of we celebs na dem dey on top the list. Na one British model follow Olajumoke,  before Adekunle Gold follow.. 
1. Olajumoke Orisaguna
2. David Bowie
3. Adekunle Gold
4. Arakangundu
5. Dede One day
6. Mark Angel Comedy
7. Alan Rickman
8. Ibinabo Fiberesima
9. Natalie Cole
10. Falz

No comments: