Wednesday, March 23, 2016

NAWA O... SEE WETIN LASTMA OFFICER DO WEY MAKE NAVAL OFFICER DEY FLOG AM FOR LAGOS



Nawa O... see falling hand O... One NAWA officer today don show one Lastma officer say levels pass levels,  uniform pass uniform. Na some of my pipu for that side yarn say dem see the LASTMA guy. 


Tori yarn us say LASTMA officer catch one truck sake of say the truck pass BRT Lane. But e come be like say na the Oga Naval officer get the truck,  who say make the Lastma guy free the truck, but the guy no gree. Na so the Lastma guy hold the side mirror of the truck,  say e no go commot and na so the mirror take break for him hand,  na so Oga Naval officer vex start to dey flog the LASTMA officer. Chai.... SEE oppression. E no good O!

No comments: