Popular Comedian wey be woman, Lepacious Bose don climb on top her Instagram page go yab celebs say all of dem abandon Nomoreloss wey kpain on the 21st of March, say na when he die finish dem come dey celebrate am but Broda Lekan, Amadeus no gree O, as him too don climb on top instagram go talk him mind.
Azadus say he no believe say person Bo get person number or say he no dey call am everything no mean say he no be beta friend and e no mean say dem no be Padi. He say person wey no check you fit believe say you dey kampe, he say when he hear say Nomoreloss get deal from Yanks, he follow am chat take celebrate him achievement. Azadus say na pipu wey Sabi say he dey sick, wey no talk am come out him go blame, COS if to say dem don talk am nieven spoke wiv the guy who signed him. See, i'll rather put the, everybody wey suppose know go know. He say he no go gree make anybody make am feel like say he be bad person.
No comments:
Post a Comment