This kain thing dey be person like film trick, but when you see am well, you go come confuse. Especially as per the kain meaning wey dis weekend get for life of Christians dem.
Na so one person for Zimbabwe climb on top Facebook go share dis pinshures today of wetin appear for sky for Zimbabwe dis morning. The thing be like 3 men on top horse as we dey see am for films and den dey in the move. The pinshure fit make person fear O, especially if person hand no too clean. Toor.... No mata wetin be the meaning, God abeg temper justice with mercy O.
No comments:
Post a Comment