Sunday, March 6, 2016

BEN CARSON SAY HE NO WAN BE U. S. A. PRESIDENT AGAIN

US Republican, Ben Carson don withdraw from him hustle say he no do again O,  he no wan become the presidential candidate again for him party dis 2016 election wey dey come. Mr Carson, na former retired neurosurgeon, and he don tey wey he dey campaign but Sha he don stop am now for some months after he no try for foreign affairs mata and questions wey dem ask am about him background story. When he Dat talk he say even if he commot from the Mata,  plenty pipu like am even if dem no go vote am,  so no shaking,  he go still dey do him best for him country. But he Neva yarn which of the other pipu wey dey contest him go like support for him party. Dem don first polongo am on Friday as the new Chairmo of My Faith Votes – one group wey dey encourage Christians make dem vote for elections.

No comments: